President Ruto speech today: Full speech of Kenya president on Finance Bill 2024 – Notice Important Online

Wia dis foto come from, Reuters

Kenya President William Ruto don make u-turn ontop di Finance Bill 2024 wey cause kasala for di kontri.

President Ruto tok for di nationwide address wey im give for Wednesday 26 June, 2024 in Nairobi.

Di president tok afta di youths of Kenya protest against di bill.

One bold and new generation of young Kenyan protesters bin enta streets to force di goment stop some of dia unpopular tax proposals.

Wetin start as anger on TikTok about one controversial finance bill bin rocket into a revolution – and no be political parties organise dem.

On Tuesday, hundreds of protesters wey wear trainers, wey feel say Kenyans dey already overtaxed wit little to show for am, face police wey fire tear gas to march enta di capital, Nairobi.

On Wednesday, President Ruto say im dey ready to work wit di young pipo afta di protest bin lead to di death of young pipo.

‘I no go sign di finance bill.”

“E dey process, sake of say we don comot di finance bill to follow young pipo tok – we go listen to dem, listen to dia needs, dia ideas and wetin dem think.”

Wetin Ruto tok ontop di finance bill protest

President Ruto bin claim say ‘criminals’ don hijack di anti-tax protests wey dey happun now for im kontri.

Ruto tok say organised criminals don “enta and hijack,” di anti-tax protest as im bin dey address di violent I-no-go-gree wey bin occur on Tuesday.

“E dey very painful for Kenya say dangerous pipo don hijack conversation wey important like dis,” im kontinu.

“E no dey in order say criminals wey dey pretend to be peaceful protestors fit raise terror against di pipo – and expect to go scot free.”

E say im goment don deploy all available resources to fight di pipo wey dey “undermine di security of di kontri”.

Di president describe di protest as threat to national security.

E add say im goment go treat evri threat to national security as “existential threat to our republic”, and say all di actors wey get hand for di threats dem go see dem as “treasonous”.

Still di Kenya leader say di protester raise “important question” wey dem need to address differently.

E no forget to thank di young pipo wey bin champion di protest for raising all dis important questions as im say, dem must to “conduct am for manner wey respect di rule of law and respect for institutions”.

Police for Kenya capital, Nairobi, shoot, kill at least five pipo during one big protests against plan to increase tax, according to Kenya Medical Association.

Wetin Kenya goment first comot for di Finance Bill

VAT on bread, vehicle and sugar

Kuria Kimani wey be di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di taxes and levies wey dey imposed for di finance bill no go dey again.

Kimani tok say di 16% VAT wey dey ontop bread go comot. E say e go lift di burden on di pipo.

Im also announce say di Kenya goment don comot di 2.5% wey dem bin dey propose to impose ontop vehicle.

Kimani also announce di removal of excise duty ontop vegetable oil. For di same statement, di chairmo say VAT ontop transportation of sugar go also dey removed.

Increase in mobile money transfers and VAT on financial services

Di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di increase for mobile transfers no go dey again. Im tok am wen im bin dey read di statement on Tuesday.

“Increase for mobile transfer no dey,” Kimani tok.

Di VAT ontop financial services and oda foreign exchange transactions go also comot, according to Kimani.

Levies on Housing fund and locally manufactured products

Kimani say products wey be locally manufactured no go attract Eco Levy. Im add say e go help boost di manufacturing capacity for Kenya.

“Locally manufactured products wey include sanitary towels, diapers, phones, computers, tyres, and motorcycles, no go attract di Eco Levy,” Kimani tok.

Di chairmo add say di levies ontop Housing Fund and Social Health Insurance go become income tax and “e go put more money for di pockets of employees.”

Source link

President Ruto speech today: Full speech of Kenya president on Finance Bill 2024 #President #Ruto #speech #today #Full #speech #Kenya #president #Finance #Bill

Source link Google News

Source Link: https://www.bbc.com/pidgin/articles/c7224g2kppyo.amp

President Ruto speech today: Full speech of Kenya president on Finance Bill 2024 – Notice Important Online

#Finance – BLOGGER – Finance, Bill, Finance, full, Important, Kenya, Notice, Online, President, Ruto, speech, Today

Author: BLOGGER